OYINBO AT RESTAURANT

E get one particular restaurant wey i dey go chop 4 G.R.A. E get one oyinbo wey dey always come chop there too...

Anytime dis oyinbo chop finish, he go shout ''Hey'', so I wonder wetin dey make am shout. I decided to chop wetin d oyinbo dey always chop so maybe me self go shout too. When I reach d restaurant yesterday evening, I order wetin d man dey chop. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am finish, i no shout.

I collect extra plate, but i no still shout. I say dis oyinbo na mumu o, wetin dey make am shout like dat? Na so i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d extra plate too na another N75,000. Na then I shout hey! heyy!! heyyy!!!  heyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy...........Up till now, I still dey shout .... No laugh alone make someone laugh with u too..

Comments

Popular posts from this blog

UNIVERSITY OF ADULTERY FINAL YEAR EXAMS COURSE: MARRIAGEMATICS

PM HUMOUR

MAGIC BRILLIANT BOY